The proverbs e talk make sense, na for am to edit the post to pidgin.
Yes, im proverbs make sense but as e nor put am for d right angle na im make me nor pour am d only single bottle of colele water wey dey my fridge.
I go like am make awa people dey yarn here in pidgin so dat those of us wey nor too go school or wey use slate write for school go fit cope with wetin dem dey yarn.
Na beg I beg us, make wey desist from using English dey yarn here. Make we help promote awa own flavour through pidgin.